lirik.web.id
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

lirik lagu bantu (crew) – disrupt the programme

Loading...

[intro~ crowd chant]
freedom, freedom, freedom…..

[chorus]
we must to disrupt the programme
pour sand sand for their gari
regain our freedom by any means necessary

[verse 1]
oga no tell me say make i hold my anger
make i no make noise make i cooli temper
when herdsmen dey slaughter, massacre we brother
from benue, ekiti, enugu, zamfara
hundreds dey die dey peme like fly
blood e dey flow government dey turn eye
silent indifference dem go play with our sense
point hand for libya to bury di matter

[chorus]
we must to disrupt the programme
pour sand sand for their gari
regain our freedom by any means necessary

[verse 2]
how long we go dey wait dey sit down debate
dey waste our saliva dey yan for social media
nothing go change if we no organise
call out their bullsh~t and cut them to size
na we get di strength na we get di numbers
nothing to fear my brother rise up my sisters
by vote or by force we must wipe di slate clean
this yẹ́yẹ́ politirikshians must enter dustbin

[chorus]
we must to disrupt the programme
pour sand sand for their gari
regain our freedom by any means necessary

[bridge]
freedom – the clock is ticking
freedom – it’s all or nothing
freedom – don’t come for begging
freedom – stand for something
freedom – it’s all or nothing
freedom – the clock is ticking
freedom – we done with talking
freedom – just stand for something


Lirik lagu lainnya:

LIRIK YANG LAGI HITS MINGGU INI

Loading...