lirik.web.id
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

lirik lagu aiken voka – firewood

Loading...

intro: aiken voka
*clears throat*
ehen…. ewo

verse 1: aiken voka
body no be firewood na for married people
so if you never ‘couple’ make your spear part gentle
but my guy no dey gree, e dey like chop outside
even the one wey don marry, e dey like sneak south side

na so one day him park him car for road carry ziporra
funny enough him wife for house, her name na deborah
ziporah tight like wetin them take nut take screw
meanwhile deborah friend, she later catch them two

now just a few hours later
bad news come reach deborah
fire on the mountain, my guy sodom and gomorah
person nearly turn to “salt” that day, “angelina jolie”
body na firewood and she for cook using him body

chorus: aiken
body na firewood (x3)
body na firewood until you say ‘i do’
(repeat chorus)

verse 2: deo

first off, let me start this by introducing myself
i am the casing for your soul and spirit also known as your flesh
the physical component of you i keep you grounded on earth
okay, gravity does that but truth is i really help

i’m really not complaining but i’d like to suggest
that you practice refraining from indulging my request
except this one of course, otherwise i’d take you off course
not for any malicious reasons but just because

i’m like a baby throwing tantrums when i want something
and if i get one i’m gon want more so stop messing up
saying body no wood hommie… coz you know the rules hommie
see these road signs and speed limits are all for your good only

chorus: aiken
body na firewood (x3)
body na firewood until you say ‘i do’
(repeat chorus)

verse 3: aiken
this life dey make me wonder, how e go be for yonder
when boys no dey smile for here and the girls dey hunger
money or lust, them ready to the enter
na serious issue be this wey dey make me want run mental

body na firewood hommie, what would jesus do hommie
him go p-ss the test, no be tigerwoods hommie
this is what we do, f.y.i by grace
by ourselves we go kpafuka for road as we run this race

now, this one no be song wey go send you on a guilt trip
coz my god, yeah he still forgives sin
so come boldly to the throne and obtain mercy
he even works in you so you fit to please him

your body na him temple and na there him dey kack
so all the dirty wey dey inside, tell them make them pack
your body na firewood until you say ‘i do’
now, keep your body safe for the right cashew
i say body na firewood until you say ‘i do’
now, keep your body safe for the right cashew

chorus: aiken
body na firewood (x3)
body na firewood until you say ‘i do’
(repeat chorus)


Lirik lagu lainnya:

LIRIK YANG LAGI HITS MINGGU INI

Loading...