lirik.web.id
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

lirik lagu 2shots – odeshi

Loading...

i dey my own for class jegeli
this agbaya enter class
and him built heavily
definitely, ehn
this guy grab men, no doubt
when he pull shirt na so the whole class just shout
yeb, yeba, yeba
some use window cut out
even my teacher respect em self
just close mouth
the bobo come short well well like small stout
with characteristics of a well brought up lagos tout
i no dey owe the guy but my guy tight sha
my men dey tell me otherwise
2shotz you no go ja
my pastor say
my son thou shall not fear
when hot p~ss fill my bladder as my guy near
boy you no dey yan where i dey
misbehave where i dey
but now you don dey pull grounds this years wey i dey
see this small boy sef
rant with you no go tey
na one blow, you going straight
wey you die, you don ah
you think say na the gym wey you dey gym
be your advantage
you never hear of small boy lepa wey dey rampage
my guy cool down
you never hear of david and goliath
the ant and the elephant
make we no go into that
some people get their power for different settings
some na from their big mouth
dem dey use run things
some things dey wey we no suppose do brag for
so therefore behave yourself
wagbon
bia nwoke iche ni siri ike
odeshi
my guy you think say you strong
odeshi
nanya take your time
mind yourself, one blow
and your blood go dey flow
odeshi
bia nwoke iche ni siri ike
odeshi
my guy you think say you strong
odeshi
nanya take your time
mind yourself, one blow
and your blood go dey flow
when man fall down
no be the end of en life
eh stand well well when person won chook you knife
ah ah, i look left, i look right
my liver fail me
na only me dey here
and i fit loose this fight
you won try me ehn
you won try your father
today i go show you say khaki no be leather
the guy hold me for throat
hold me for trouser
i begin beg for yoruba, and igbo and hausa
the sweat wey i sweat fit full one bucket
my eyes don red nearly fall from en socket
pow, one for head
pow, one for chest
see me wey dey talk dey fall
my liver rest
people wey dey pass come dey help me beg the guy
dem be just dey gather
see en blow one for eye
everybody clear
leave us for there
oh boy you’re on your own oh
ah ah this is not fair
na my phone don miss
and i dey very p~ss
i look at this guy ah ah
what the h~ll is this
i give am blow for face
but en still hold my waist
this guy too strong but en no get crase
i look round, around
i see sand for ground
i took me a hand full
and threw it at his face
yay my eye, yay my eye
if i cath you my guy you don die
catch who, catch who
shey na me, shey na me
you don gock am, you don gock am
terribly
as i see say the sight don dey briefly impaired
i break bottle for en head
bia nwoke iche ni siri ike
odeshi
my guy you think say you strong
odeshi
nanya take your time
mind yourself, one blow
and your blood go dey flow
odeshi
bia nwoke iche ni siri ike
odeshi
my guy you think say you strong
odeshi
nanya take your time
mind yourself, one blow
and your blood go dey flow
odeshi
anyi abiala bia k’anyi gawa
eh 2shotz umuunnamo (4x)


Lirik lagu lainnya:

LIRIK YANG LAGI HITS MINGGU INI

Loading...