lirik.web.id
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

lirik lagu yosa oku - rubbish talk

Loading...

hit me, yeah uh
i go show you now, who be the wizzy wiz, whoo
i no dey like dem nonsense, all dem dey talk na fake sh~t
all dem dey talk na money, all dem dey talk na woman waist
or dem go say from london, down to soweto
from america to england, from brazil to austria
i know say hungry dey beat you, i know say you must to chop now
but no dey make all that silly songs
wey dey rotate our youngin ones, and when dey make their head dey spin
na you dey influence the youngin ones, so make you do the things right now
or i go tell you onе time now

i don’t like your fake ass, all you dеy talk na nonsense
i no dey like your fake yansh, all you dey talk na rubbish
i no dey like your fake ass, all you dey talk na rubbish
i no dey like your nonsense, all you dey talk na rubbish

as i turn on my radio, all i hear inside yeye songs
if dem no sing about money o, dem go dey sing about woman waist
now i know say hungry dey beat you
naim make you now you dey worship money
naim make you now you dey lord money
you dey sing about money now
don’t you know if you dey sing about money now
you done dey worship money be that
don’t you know if you dey sing about waist
you done dey worship waist be that
and the one wey dey pain me pass for inside be say
all the youth dem dey listen think say una be the way
and the other one wey dey pain me be say
dem go still dey call god name inside all of dem sh~t
i don’t like your fake ass, all you dey talk na nonsense
i no dey like your fake yansh, all you dey talk na rubbish
i no dey like your fake ass, all you dey talk na rubbish
i no dey like your nonsense, all you dey talk na rubbish
i don’t like your fake ass, all you dey talk na nonsense
i no dey like your fake yansh, all you dey talk na rubbish

they talk about how he dey get cash
talk about how he dey get chicks
they talk about how e dey get bar
how he dey travel the whole world
they trap, they talk about the wrong sh~t
they talk about how he de dey thrill
they talk about how he be bad man, hmmm nonsense

dem say dem get cash now
dem say dem get fans now
dem say dem get money
dem say dem get all the woman
dem say dem get all the fans now
na who be the fans, na people
na mislead you dey mislead now
na mislead you dey mislead now
i done tell you now
na mislead you dey mislead now
you want to trap dem for your market
you want make dem lost in there
eledumare punish you now
osalobua punish you now
na chineke go punish you now
chukwu go punish you now
i don’t like your fake ass, all you dey talk na nonsense
i no dey like your fake yansh, all you dey talk na rubbish
i no dey like your fake ass, all you dey talk na rubbish
i no dey like your nonsense, all you dey talk na rubbish
all you dey talk na rubbish
all you dey talk na rubbish
all you dey talk na rubbish
na rubbish, oh

comot for here with your smelly mouth
comot for here with your dirty mouth
life is deeper than money
life is deeper than the woman waist
and if i dey lie oh, eledumare punish me
if i dey lie oh, make chineke punish me
chukwu punish me oh, punish me
if i dey lie oh, osalobua punish me
chukwu punish me, olorun punish me
osiris punish me
horus punish me


Lirik lagu lainnya:

LIRIK YANG LAGI HITS MINGGU INI

Loading...