lirik.web.id
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

lirik lagu krexx nv - state of mind

Loading...

[intro: krexx nv]
and it’s krexx on this
high spirit

[verse 1: krexx nv]
them call us leaders of tomorrow—when tomorrow wan reach?
i don tire for sardine, abeg show me sea
carry me along, my guy, like your babe handbag
you no fit wish to dey my shoes when i dey wear sandals
like who dem feed on v~~gr~—everywhere don hard
i for get last card with me if i no need find chow
i know say suffer na test and all these hardship na prank
i for like call god today, but i dey owe mtn card

life na b~tch—na okpo, but i plan make her bleed
pride goes before a fall, and nothing grow reach greed
silеnce na costly weapon—well, talk still chеap
i lay my bed for morning, for night i rest in peace

the streets made me from dust to solid substance—no ask me how
na garri na him dey form eba
to treat your f~ck~up, my guy, i no need first aid box
deliver for any beat—i no need nine months
bars!

[hook: richie spencer]
i dey holla, give my brother—i no fit form sh~t for you
i for make my day today—i for bring all the morning through
anytime my maga come pay
i dey feel like buhari too
many men commit
many, many, many men commit
ye!
[verse 2: krexx nv]
i lay my bed for morning—for night i rest in peace
i don’t give a f~ck, i no even dey try unzip
the country when we live, man, e dey unbearable
biafrans na terrorists, herdsmen na angels though

church na plan b when your business don fail
we never hear from evans since—abi e don escape?
funerals and festivals—i no fit differentiate
life na business to sars—you gats negotiate

it’s a small world—welcome to the wild west, bro
cheat nature anyhow—we no need expo
communication na sk!lls, music na talent
k!ll rappers on their tracks—i no get conscience

money yab man, money turn comedian
flows tight anyhow like igbo man hand
no beef—i dey fast (follow come charger)
i no dey wheeze with my words—i dey grow dada
bars!

[hook: richie spencer]
i dey holla, give my brother—i no fit form sh~t for you
i for make my day today—i for bring all the morning through
anytime my maga come pay
i dey feel like buhari too
many men commit
many, many, many men commit
ye!
[outro: richie spencer & krexx nv]
richie spencer:
i no fit form sh~t for you

krexx nv:
na so we see am o

richie spencer:
i for bring all the morning through

krexx nv:
love na verb for the streets

richie spencer:
anytime my maga come pay

krexx nv:
lock door when you dey baff—make them no see you finish

richie spencer:
i dey feel like buhari too

krexx nv:
it’s krexx on this

richie spencer:
many men commit
many, many, many men commit
yeh!


Lirik lagu lainnya:

LIRIK YANG LAGI HITS MINGGU INI

Loading...